You don land for #KnowYourRightsNigeria
We don arrange your rights so tey you fit locate am anywhere anytime wey you want am, the only tin wey you go do na to press am for your phone (App). E don tey wey plenty of us dey fear Police, LASTMA (for those wey dey Lagos), FRSC and all the other type of Eke dem wey dey Obodo Nigeria. We no suppose fear these our people, na becos we no too sabi all the plenty plenty rights and advantages wey the Law pack give us, and plenty people don see beta gbege for this we country sake of the tins wey dem no sabi. This #KnowYourRightsNigeria app na the final bustop! E go helep you sabi all the rights and advantages wey be your own for this Naija. Everything wey we arrange put for hia go helep you stand gidigba anytime wey anybody wan shakara you or do anyhow for ya side or to pesin wey you sabi.

Company wey translate our rights for pidginPEMORAD DIGITAL TECHNOLOGIES LTD
Take your hand torchlight any of this rights wey dey for under, information wey go catch ya eye brekete dey for there wey fit helep your condition or even condition of pesin wey dey your corner.
We get arena like village square wey you fit come table for we Lawyers dem, ask any human right mata wey dey pepper you for body. The one wey we sure say go totori you for body be say we Lawyer dem don arrange say you no go pay shishi!.
Abeg no forget: We Lawyer dem don beg us make we beg una say na only human right mata dem go answer on top dis our App o. if you get any other matter wey dey disturb you for body, like say debt chook leg enter ya business, you get quanta with ya bank or pesin, or ya container for high seas wan get K-leg, or unto any business mata sha, make you no waste time o, quick quick carry the mata go meet your own Lawyer.
We get where you go press incase you wan carry any human rights mata go doormat to any Govment gumbody for Obodo Nigeria, e fit be the gumbody wey we dey call National Human Rights Commission, e fit be dem Police gumbody wey be Nigerian Police Force, e fit be NCC, CPC, Oga them for LASTMA , in short all the other gumbody wey boku for we area. We believe dem die say dem go carry your mata ontop dia head as dem fit.
But wait, sake of say you get this our #KnowYourRightsNigeria App or unto say you don chop am front to back no suppose make you go dey do oversabi o! We knee down for ground dey beg make you no forget say na as your Lawyer talk, na so make you dey waka. No ever waka on ya own for all dis mata abeg. We gree say e good make you sabi your rights, na why we arrange this ogbonge app for you, but to dey waka about dey do oversabi like sabinus, our hand no dey that one o
