I be journalist o. Dem fit use force sey make I mention pesin wey give me tori ontop wetin dey happen for obodo Nigeria?

If we sey press freedom, e mean sey make the press go do their work make dem no hindare them as dem dey gather information which be part of their job wey constitution don give dem right to do. Ontop weda dem must to disclose source of information, court don talk ontop this mata for the case of Oyegbemi and Others v. Attorney-General of the Federation and other sey:

Nobody get power to compel weda na editor, reporter or newspaper publisher to disclose the source wey e dey take get information for matter wey e dey publish. If he no disclose am, dat one no mean sey e don offende court. But make he no disclose na matter wey no affect national security, public safety, public order,  public morality, welfare of people or no affect disorder or crime.