Section II for Trade Union Act make am illegal for Army and police dem, the Nigerian security printing and minting company, prison services, customs preventive services, Central Bank of Nigeria, dem employees wey law permit to dey carry, Federal fire service dem to dey organize themselves or be members of trade union ontop employment purposes. Dem fit join consultative committees for dia establishment.

 

The right to dey form or join trade union dey protected under the right to peaceful assembly and association. Section 1(1) for Trade Union Act talk sey trade union means:

…group of workers or employers weda na temporary or permanent dem be to dey  to regulate the terms and conditions of employment of worker…….

 

No forget. Before association go qualify for trade union for obodo Nigeria, it supoose be for workers or employers and the mission must to dey regulate terms and conditions of workers for Nigeria.

Yes. For one popular case of  Alhaji Abubakar Rimi v. Peoples Redemption Party[1], the court talk sey this particular provision of the constitution dey applicable to people, organizations and the right allow dem make dem come together voluntarily under a political banner or leave the association any time wey em want.

[1] (1981) 2NCLR 734 HC

This one na simple mata. Apart from sey we dey list secret society and dem other, make we just sey the law no gree make you join any assembly you know sey dem dey carry out dem purpose and many for a way wey fit bring panic or cause people to dey fear or dey disturb the peace of people. Our law talk sey dem be unlawful assembly.

Again, section 88 for criminal code make am illegal for people assemble and come dey bear, wear or carry arms, or dey show symbol, emblem, banner, or flag wey dey promote calculated to promote hatred between people wey belong to different religious faith dem.

Under the law, nobody suppose force another to belong to any local association except the pesin wan join such group voluntarily. No matter the amount of shakara or threat from such local association to join them, the law no support am if you no wan join dem. If dem dey force you or dey threaten you, call your lawyer.

The your right to associate cover your right not to associate with people wey you no want or of your life go dey for danger if you still dey associate with dem. Na your choice. Many spouses don die bcos dem no run commot from some homes wey constitute or pose serious dangers to dem lives E get one popular case of Salisu v. Lawa[1], court sey na breach of constitution when dem give a decision sey make a wife go return to im matrimonial home by force when the home no dey peaceful.

[1] (1986) 2 NWLR (Pt2) 36 CA;

Yes. Your right to determine people wey you wan associate with also cover your choice of school wey you wan go. Abeg hear this one, go need to meet the admission criteria of the school wey you wan go and also abide by the school rules.

 

Our law gree sey make we protest anything wey we think sey e no good. But the rule be sey, our protest must dey peaceful or lawful. Any kain assembly wey come lead to riot, danger or killing people no be kind protest wey constitution sey we must to do.

  • Introduction

This right too dey very important and all international, regional and national laws recognize am. Na all of us like to dey assemble, associate marry, join organization as we want protect and promote our interests.

Section 40 fo our constitution talk sey:

Na all of us dey get right to assemble freely andcom  associate with other people wey we want, again pesin fit form, belong or join any political party, trade union or any association wey fit protect im interests.

 

Na two classes of rights this section provide. Na right to assemble and associate freely with other people. We need talk here sey any assembly will go cause trouble for public peace and order, dem go declare am sey e no dey for constitution.